23 “Wi si sey dem lock di prison well and all di sojas stand for di front, but wen wi open di gate, wi look inside, but wi nor si anybody.”
But di King wey dey heaven dey laf dem anyhow. Yes! God dey laf dem well-well.
God skata di nashons plan kon spoil wetin dem won do.
Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.
So, na who fit tok make sometin happen, if God nor allow am?
Den, dem kon pick stone won stone am, but Jesus hide kon komot from di temple aria.
But for dat nite, God angel open di prison door kon bring dem kom out and tell dem,
But di savant wey dem send go, nor si dem for di prison, so dem go back go ripot sey,
So wen di soja oga wey dey di temple and di priest oga dem hear dis tin, dem sopraiz well-well kon dey wonder wetin happen to di apostles.