22 But di savant wey dem send go, nor si dem for di prison, so dem go back go ripot sey,
But Pita follow dem go rish di High Priest yard. E kon sidan with di guards to si wetin go happen.
Wen day break, di sojas wey dey guide Pita sopraiz well-well and fear katch dem wen dem nor si am again.
“Wi si sey dem lock di prison well and all di sojas stand for di front, but wen wi open di gate, wi look inside, but wi nor si anybody.”
So di soja oga wey dey di temple kon escort di savant go bring di apostles, but dem nor use force, bikos dem dey fear sey di pipol wey gada der, fit stone dem.