“But before dem go happen, dem go arrest and ponish una for wetin una nor do, den go karry una go judge for inside sinagog, den dem go trow una inside prison. Dem go karry una go meet kings and govnors, bikos of my name.
Na Christ savants bi? (I don dey tok like sey I dey kraze again!) Misef na Christ savant wey betta pass dem! I don work hard pass dem, I don dey prison plenty times pass dem, dem don beat mi well-well pass dem, I don nearly die plenty times.
Make yu nor fear di tins wey yu go soon sofa. Devil go trow some of una inside prison, so dat e go test una. Yu go sofa for ten days. But make yu nor live mi, even if e mean sey yu go die. Bikos I go give yu di crown wey bi life.