Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.
But wen e si many Farisee and Sadusi pipol dey kom make e baptize dem, e kon tell dem, “Una, snake shidren! Who warn una about God judgement wey dey kom?
But di Jew pipol dey jealous, so dem kon gada aria boys wey dey waka about for market, take form gang to skata di town. Dem attack Jason house, bikos dem tink sey Paul and Silas dey der, so dat dem go bring dem out kon take dem go di town hall.
bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom!