15 sotey dem even dey karry pipol wey nor well put for bed and mat for road, so dat as Pita dey pass, en shadow go heal dem.
Time dey to kill and time dey to heal pesin; time dey to skata and time dey to build.
dey beg am sey, “Make di pipol wey nor well tosh yor dress” and all of dem wey tosh am, kon well.
Bikos di woman don tink am for en mind sey, “If I go fit tosh en klot korna, I go well.”
Di pipol run pass all di aria, karry di pipol wey nor well for mat go where dem hear sey Jesus dey.
I tell una true word, di pesin wey bilive mi, go do di kind mirakle wey I dey do and e go even do di ones wey big pass dem, bikos I dey go meet my Papa.
Afta dis tin don happen, many pipol wey nor well for der kon still kom and e heal dem.
Dem bring pipol well nor well and doz wey get evil spirit from all di town and village wey near Jerusalem and God heal all of dem.