Di man ansa, “Who sey make yu kom judge us? Yu dey plan to kill mi as yu take kill dat Egypt man?” Den Moses kon dey fear, so e tink kon sey, “True-true, pipol don know wetin I do.”
Afta Jesus enter di temple, di priest oga dem and di eldas kon ask am wen e dey tish sey, “Na wish pawa yu take dey do all dis tins and who give yu di pawa?”
Di pipol wey sabi di law and di Farisee pipol kon bring one woman wey dem katch sey e sleep with man wey nor bi en husband. Dem kon make am stand for dia front,
Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey komot for der one-by-one. Na di old pipol first start to komot, till e remain only Jesus and di woman wey stand for en front.
My pipol and di oga dem for Israel, make una know sey, Jesus Christ wey kom from Nazaret, di pesin wey una kill and God raiz am from deat, naim name make dis man wey una dey si so, well.
So dem bring di apostles kom back kon tell dia savant make dem flog dem. Afta dem release dem, dem kon warn dem sey make dem nor use Jesus Christ name take prish again.