Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 3:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Wen Pita si sey all di pipol gada, e kon start to dey prish, “Israel pipol, wetin make dis mirakle dey sopraiz una like dis? Why una dey look us like sey na with awa own pawa or holiness wi take make dis man waka?

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 3:12
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem ansa, “Wi dream one kind bad dream, but e nor get anybody wey fit tell us wetin di dreams mean.” Josef ansa, “Nor bi God dey tell pipol wetin dreams mean? Make una tell mi di dream.”


Josef kon ansa Fero, “I nor get dat kind pawa, but God go tok thru mi, so dat yu awa king go dey okay.”


Anybody wey dey tok with en own pawa, go wont make pipol praiz am, but di pesin wey won honor who send am, naim dey do wetin korrect and sin nor dey inside am.


So my brodas, wey bi Abraham shidren and una wey bi Gentile pipol wey dey fear God, na di message about how God go take save pipol, naim wi kom tell una so.


“Israel pipol, make una hear wetin I dey tok, Jesus Christ wey kom from Nazaret, di man wey God choose and wey e send to una, wey God use do many mirakles and oda wonderful signs for una front, as all of una know,


Di man still dey jump follow Pita and John with happiness and di pipol still dey sopraiz. Den di pipol run go meet Pita and John for di place wey dem dey koll “Solomon Varanda.”


Na Abraham, Isaak, Jakob and awa grand-grand papa God, naim karry en savant Jesus Christ go up, di one wey una rijet kon gi-am to Pilate make e judge am, even wen e won free am.


I dey ask, God don rijet Israel, en pipol? No! Mi too, na Israel pesin, I bi Abraham pikin wey kom from Benjamin tribe.


wey bi Israel pipol, go fit asept Christ. Na dem God choose as en own shidren, E make agriment with dem kon give dem en law. Na dem get di temple and wetin God promise.


Wi nor dey sey wi go fit do all dis tins by awasef, but na God give us di pawa wey wi take do dem.


Den one for di eldas kon ask mi sey, “Dis pipol wey wear long white klot so, where dem from kom?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ