9 Afta dis tin don happen, many pipol wey nor well for der kon still kom and e heal dem.
So di news about Jesus kon spread go evriwhere for Siria. Dem kon bring pipol wey nor well, wey nor fit waka, pipol wey devil dey worry and di pipol wey demon dey inside dem, kom meet am and e heal all of dem.
Wen dem don cross di whole Island go rish Pafos, dem kon si one magician wey bi Jew and na wayo profet. En name na Bar-Jesus,
Dem kon dey praiz us well-well and wen wi won go, dem give us evritin wey wi nid.
Publius papa kon get fever and en belle dey pain am. Paul go si am kon heal am.
Na dis kind mirakle and wonder God do thru di apostles for di pipol front and dem kon dey meet for Solomon Varanda.
sotey dem even dey karry pipol wey nor well put for bed and mat for road, so dat as Pita dey pass, en shadow go heal dem.