Make una heal pipol wey nor well, wake pipol wey don die; cure lepers and drive demons komot from pipol body. Na free God give una dis pawa, so make una gi-am free to oda pipol too.
But Pita drive all of dem go outside, den e knee down kon pray. E turn face di dead body kon sey, “Tabita, get up!” Naim di woman open en eye and wen e si Pita, e kon sidan.
So for di church, God first choose apostles, before profets and tishas. E still choose some wey dey do mirakle, odas wey dey heal sick pipol, some wey bi leaders and odas wey dey tok with difren-difren language.