5 But Paul shake di snake komot from en hand enter di fire and nor-tin do am at-all.
Una go mash lions and kobra pass; una go mash wiked lions and snakes go dey under una leg!
dem go fit whole snake and if dem drink poizin, e nor go do dem anytin; dem go put dia hand for pipol wey nor well body and di pipol go well.”
Make una listin, I don give una pawa to waka on-top snake and skorpion and to ovakom all di enemy pawa, so nor-tin go fit wound una.
But dem dey tink sey en body go swell-up or e go fall for groun die. So afta dem don wait for sometaim kon si sey nor-tin happen to am, dem kon shange mind sey, Paul na god.
And God wey dey give peace, go soon distroy Satan for una. Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una.