29 Wen e tok finish, di Jew pipol kon leave der dey vex among demsef.
“Make una nor tink sey, I bring peace kom dis world. No! Na war I bring.
Una tink sey na peace I bring kom dis world? No, I kom divide una!
Wen pipol hear wetin e tok, some for dem kon sey, “True-true, dis man naim bi di Profet!”
So dem kon go, but dem nor gri among demsef afta Paul sey, “Di word wey di Holy Spirit tok thru di Profet Isaya, na true
“So make una know sey, dis salvashon wey God bring, dem don karry am go meet Gentile pipol, bikos dem go asept am!”
So for two full years, Paul stay der for en own house wey e rent and e welkom all di pipol wey kom meet am