“Go gada all Jew pipol for Shushan, den make una fast and pray for mi. Make una nor chop or drink anytin for three days and nites. Mi and my savants go do di same tin. Afta di fasting, I go-go meet di king, even doh dat kind tin dey against di law. If na dat one go make mi die, den make I die.”
Jesus koll en disciples kon tell dem, “I dey sorry for dis pipol bikos dem don dey here with mi for three days and dem nor get anytin to chop. I nor wont make dem go back with honga, so dat dem nor go faint for road.”
Afta dem don stay without food for many days, Paul stand for dia front kon sey, “My pipol, if to sey una listin to mi wen I sey make wi nor komot for Krete, wi for nor si all dis wahala.