Wen di kaptain for di ship si am, e kon wake and ask am, “How kom yu fit dey sleep for dis kind time? Make yu get up kon pray to yor God make E kom help us. May bi E go sorry for us kon save awa life.”
Dem trow long rope wey dem tie sometin put inside di wota to measure how e deep rish and dem si sey di wota still deep rish 40 metres. Afta e don tey small, dem trow am again kon si sey e don bi 30 metres.
Den di sailor try to run leave di ship, dem take di small boat for di ship, put am for wota kon dey play wayo sey dem won go put big shain down for di ship front,
Bikos na only one hour God take distroy dis big town finish!” And evry ship, dia kaptain and pasenja, plus evribody wey dey work for sea, go stand far,