15 Wen dis breeze trap di ship and wi nor fit si well-well again, wi leave di ship give di breeze and e kon dey karry us go where e like.
Afta di kold breeze, one strong breeze wey dem dey koll, “Hurricane”, kon dey blow kom from di Island.
As wi dey run go hide under one small island wey dem dey koll Kauda, nor bi small wahala, before wi fit kontrol di ship.
Afta fourteen days, as di breeze dey karry us pass di Adriatik Sea for mid-nite, di sailors kon dey suspet sey wi don dey near land.
Look ship for wota: E big well-well and na strong breeze dey fit push am, but na one small wheel di driver dey use take kontrol am.