14 Afta di kold breeze, one strong breeze wey dem dey koll, “Hurricane”, kon dey blow kom from di Island.
But wen di men wey dey padol una ship, padol am rish di river centre, one wind from east go kom sink di ship.
At wons, strong breeze kon dey blow for di sea and wave won sink di boat. But Jesus Christ dey sleep.
Den, strong breeze kon dey blow and wota dey enter di boat, so di boat kon dey won sink.
Wen dis breeze trap di ship and wi nor fit si well-well again, wi leave di ship give di breeze and e kon dey karry us go where e like.