Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 26:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 sey, awa twelf tribes go gain as dem dey use all dia mind dey serve God, both day and nite. My king, na bikos of dis hope wey I get, naim make di Jew pipol dey akuiz mi so!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 26:7
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For di dedikashon, dem offa 100 melu, 200 sheep and 400 lamb as sakrifice and 12 goat as ofrin for sin, one for each tribe for Israel.


All di pipol wey kom back from Babilon bring ofrin wey dem won sakrifice give Israel God. Dem offa 12 bull for Israel pipol, 96 ram and 77 lamb; dem still offa 12 goat to klean demsef from sin. Dem burn all dis animals as sakrifice give God.


Una wey dey serve for di kourt wey dey God temple;


Jesus ansa am, “I tell yu true word, for dat time wen evritin go dey new, Man Pikin go sidan for en throne wey get glory and una wey dey follow mi, go sidan for twelf thrones, dey judge di twelf tribes wey dey Israel.


One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel.


For my kingdom, una go sidan chop and drink for my tabol and una go sidan for difren thrones dey judge di twelf tribes for Israel.


So make una shine una eye and remember sey, for day and nite for three years, I nor stop to dey kry, as I dey warn una.


I get hope for God (di kind one wey dis men get too) sey one day, pipol wey don die, weda na bad or good pipol, go wake-up.


“King Agrippa, about all dis tins wey di Jew pipol dey akuiz mi sey I do, I tank God sey I won defend mysef give yu today,


bikos yu know all awa tradishon and di matter wey di Jew pipol dey akuiz mi about. So, Abeg, make yu listin to wetin I won tok.


Bikos of dis, I kon sey I won si and follow una tok first sey, na bikos of di hope wey Israel get, naim make dem use dis shain tie my hand so.”


so dat mi too go still wake-up from deat, as e wake.


Wi dey pray with all awa mind for day and nite sey, make God let us si una again kon let una know evritin wey una suppose know about una faith.


Naw, woman wey en husband don die and e really dey alone for dis world, dey trust God. E dey pray for nite and day sey make God help am.


Mi James, wey bi God and Jesus Christ savant, dey greet una wey bi di twelf tribes wey dey for evriwhere for di world.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ