32 Agrippa kon tell Festus, “Wi for fit release dis man, if to sey e nor sey make Caesar judge en kase.”
Afta two years, Porcius Festus take-ova from Felix and bikos Felix one make di Jew pipol happy, e kon leave Paul for prison.
But I kon si sey e nor do anytin wey go make dem kill-am and wen e sey e won make di emperor judge en kase, I kon gri sey I go send am go meet Caesar.
Wen dem don kweshon mi, dem won release mi, bikos dem nor si anytin wey go make dem kill mi.
But wen di Jew pipol nor gri make dem free mi, di tin kon make mi sey, I won go Rome make Caesar for judge my kase, nor bi bikos I get anytin wey I dey komplain against my pipol.
But God tell Ananias, “Make yu go meet am, bikos I don choose am make e karry my name to Gentile pipol, kings and all Israel pipol.