Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 26:31 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

31 and as dem dey go, dem kon tell each oda, “Dis man nor do anytin wey go fit make dem kill-am or put am for prison.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 26:31
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

David si di angel wey dey kill di pipol and e tell God, “Na mi dey guilty, na mi bi di pesin wey do wrong. Wetin dis poor pipol do? Make yu ponish mi and my family.”


Den di leaders and di pipol kon tell di priests and di profet sey, “Na God name dis man take tok to us, so make wi nor kill-am.”


Den Pilate tell di priest oga dem and di pipol, “I nor si anytin wey go make mi kondemn dis man.”


I kon si sey en offence, na about wetin dem dey argue about for dia law, but e nor do anytin wey rish to kill-am or put am for prison.


So kworel kon start between dem and some oga for di law matter wey bi Farisee pipol kon stand up dey oppoz di Sadusi pipol sey, “Wi nor si any bad tin wey dis man do. Una know weda na spirit or angel tok to am?”


But I kon si sey e nor do anytin wey go make dem kill-am and wen e sey e won make di emperor judge en kase, I kon gri sey I go send am go meet Caesar.


Wen dem don kweshon mi, dem won release mi, bikos dem nor si anytin wey go make dem kill mi.


But make una do am with gentolness and respet, dey make sure sey una mind klean, so dat pipol wey dey tok bad about di good tins wey una dey do for Christ, go shame for di bad wey dem dey tok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ