25 But Paul ansa am, “I nor dey mad oga Festus, but na betta word wey dey good naim I dey tok so.
‘God don make yu priest instead of Jehoiada. E put yu for en temple so dat yu go dey kontrol doz kraze pipol wey dey pritend sey dem bi profets. And na yor work to tie dat kind pesin for groun.
My oga Teofilus, since I follow evritin from biginnin, I kon tink am sey e good make I rite wetin really happen give yu,
Jesus kon tell dem, “I nor get demon. I dey respet my Papa, but una nor gri respet mi.
“From Klaudius Lysias to Govnor Felix, I salot yu!
Oga God Felix, wi dey si all dis tins wey yu dey do for evriwhere. Na evriday wi dey tok about am and dey tank yu.
E must bilive di message about God wey e dey tish, so dat e go fit tell pipol di trut and korrect doz wey dey oppoz am.
For una heart, make una make Christ una Oga God and make una ready to ansa anybody wey ask una about di hope wey una get.
Make una nor take bad pay di bad wey pesin do una, instead, make una bless odas, bikos God koll una to bless pipol.