Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 26:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 26:18
90 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make Yu open my eyes to si di wonderful tins wey dey yor law.


God dey open blind pipol eyes kon karry doz wey dey weak, go up. God love pipol wey dey fear am.


Wen dat day rish, deaf pipol go hear words wey dem read from book give dem and blind pipol go si even inside darkness.


Dia eyes nor go dey blind and dia ears go dey listin well to hear wetin di pipol wont.


Den blind eyes go open and doz wey nor dey hear, go hear word.


I go lead doz wey nor dey si, pass di road wey dem neva travel pass before. I go turn dia darkness to lite kon make rof road smooth for dem. Dis na wetin I promise and I go do dem; I nor go fail.


Yu go open blind pipol eyes, save doz wey dey darkness and free doz wey dey prison.


God sey, “Gada my pipol togeda. Dem get eyes, but dem nor dey si. Dem get ear, but dem nor dey hear!


God tell mi, “My savant, I get big work for yu; yu nor go only make Israel pipol wey survive, great again, but I go still make yu di lite for di nashons, so dat all di world go dey save.”


Pipol wey dey waka for darkness don si lite. Lite dey shine for doz wey dey stay for di land where strong darkness dey.


But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.


Jesus ansa, “Komot here, devil! Bikos God word sey, ‘Na only God wi suppose to serve and woship.’ ”


una wey dey darkness, don si big lite and una wey don nearly die, don get life.”


wey go make pipol know sey, God go save dem, bikos E go forgive dem dia sins.


so lite go shine for di pipol wey sidan for darkness and where deat dey. Den God go give us peace.”


Na-im bi di lite wey go show Gentile pipol road kon bring honor to yor pipol, Israel.”


Den e open dia mind so dat dem go fit undastand God word


and dem go use en name prish give pipol make dem for turn from dia sin kom meet God and di prishin go start from Jerusalem.’


“God Spirit dey my body, bikos E don anoint mi make I prish Good News give poor pipol. E send mi make I prish freedom give pipol wey dey prison and make blind pipol for si. E still sey make I free doz wey dem dey opress


Make yu protet dem with di trut, bikos na yor word bi di trut.


Na dis bi di rizin why God go judge di world, bikos lite don kom inside di world, but pipol like to stay for darkness instead of lite, bikos dem dey do tins wey nor good.


Jesus ansa am, “If yu know wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so, yu for ask am and e go give yu di wota wey dey make pesin live forever.”


But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”


Den Jesus sey, “Na mi bi di lite wey dey di world, anybody wey follow mi, nor go waka for darkness lie-lie, but e go get di lite wey go gi-am life.”


Jesus tell am, “I kon judge pipol for di world, so dat di pipol wey nor dey si, go bigin si and doz wey tink sey dem dey si, dia eye go blind.”


As far as I dey inside dis world, na mi bi di lite for di world.


All di profets tok about am sey, ‘Evribody wey bilive am, thru en name, God go forgive dem.’ ”


Bikos dis na wetin God don already kommand us sey: ‘I don choose una to bi lite for Gentile pipol, make una bring salvashon kom dis world.’ ”


and E nor do wayo between wi and dem bikos, E make dia heart klean by faith.


Pita ansa dem, “Make una turn from sin kom meet God one-by-one and make dem baptize una with Jesus Christ name, so dat God go forgive una, den una go fit receive di Holy Spirit.


I dey prish give Jew and Greek pipol sey make dem turn from sin kom meet and serve God and put dia faith for awa Oga God Jesus Christ.


Naw, I leave una for God hand, so make en word wey get grace, keep una. Dis word wey get grace fit make una grow and get share with all God pipol.


“So King Agrippa, I nor do strong head wen I receive dis vishon wey kom from heaven,


sey Christ sofa and e go bi di first to raiz from deat, so dat e go show di lite to awa pipol and even Gentile pipol.”


So make una turn from sin kom meet God, make E for forgive una,


But God don promote am sey make e sidan for en rite hand kon gi-am big pozishon as Oga God and di Pesin wey go save di world, so dat Israel shidren go turn from dia sin kom meet God make e forgive dem.


And if wi bi God shidren, den wi go inherit God propaty. Yes, wi go follow Christ inherit God propaty, bikos if really wi sofa with am, wi go follow am enjoy.


To God holy pipol for di church wey dey Korint, wey bi en own bikos of Jesus Christ and pipol for evriwhere wey dey woship awa Oga God Jesus Christ as dia Oga God and Savior.


Una don bi Christ friends bikos of God and na thru Christ wi get wisdom, goodness and holiness wey kom from God;


bikos doz wey nor bilive, di gods for dis time don blind dia mind, so dem nor go si lite wey dey dis gospel wey get glory and dis gospel na Christ wey bi God image.


Bikos God wey sey, “Make lite shine from darkness,” Na-im dey shine inside awa heart, so dat E go give us di lite wey show us en glory wey dey Christ face.


Make una nor make friend with pipol wey nor bilive, bikos, na wish kind friend raitiousness and bad tin won bi, or na wetin lite and darkness get togeda?


I don die with Christ for cross, so nor bi mi dey live again, but na Christ dey live inside mi. Di life wey I dey live naw, na bikos of di good tins wey God pikin do inside mi, bikos e love and die for mi.


so thru Christ, Abraham blessings go kom meet Gentile pipol and wi go receive di Spirit wey God promise us, thru faith.


Na di tin wey I won know from una, bi dis: Una receive di Spirit, bikos una dey do wetin di law tok or na bikos una bilive wetin wi prish give una?


All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,


God deposit dis Holy Spirit for di tins wey wi go inherit, until di time wen E go save en pipol, so dat all praiz and glory go bi en own.


Una eye don open to undastand di grace wey God koll una kom enter and una don si how di blessing wey E promise en pipol, plenty rish.


Na thru Christ blood wi take get salvashon and na dis blood make God dey forgive us awa sins, bikos en grace big well-well.


God save una with en grace, bikos una get faith (as una don bilive Christ), nor bi with una own pawa, but na God give una.


Dia mind dey for darkness and dem nor get part for di life wey God dey give, bikos dem sturbon and nor fit undastand.


Make una nor put hand for bad tins, instead, make una dey espose dem.


Bikos na lite dey make evritin shine kom out and na dis make dem rite sey: “Wake-up; yu wey dey sleep! Make yu raiz from grave and Christ go shine for yor life!”


Before-before, una dey for darkness, but naw, una bi lite wey dey shine inside Christ. So make una dey do tins like shidren wey get lite,


Bikos, wi nor dey fight against human being, but na against di wiked rulers wey dey for dis world, against evil spirits and pawas wey dey di heavens.


Den dia sense go korrect and dem nor go fall enter devil trap again. Bikos devil don katch dem put inside en trap before, so dem dey do anytin wey e wont.


Bikos Jesus do wetin God wont, all of us don dey holy thru di sakrifice wey e use en body make for us.


Na with one sakrifice e take klean pipol from dia sins and dem don dey klean forever.


Nobody fit make belle sweet God without faith, bikos anybody wey dey kom meet am, must bilive sey, E dey alive and E dey reward pipol wey dey find am si.


Na dis make am bi middo-man for di new kovenant, so dat pipol wey e koll go fit receive di propaty wey go dey forever. E promise us dis propaty, wen e die to free us from di bad-bad tins wey wi don do wen di first kovenant still dey.


My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?


Dem born us put for inheritance wey nor dey spoil, dirty or fade. God keep di inheritance for heaven for us


Before-before, una waka komot for di rite road like sheep wey lost, but naw, una don turn back go meet di Shepad and Pesin wey dey guide una soul.


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


But if wi konfess awa sin to am, e go forgive us kon wosh evritin wey nor good for God eye komot from awa life, bikos Christ dey always do wetin e sey e go do, since e dey raitious.


My shidren, I dey rite give una sey God don forgive una sins, bikos of Jesus name.


But pesin wey dey like to sin, na devil pikin, bikos devil dey sin from di biginnin. Na dis one make God Pikin kom dis world, so dat e go skata all di work wey devil dey do.


Wi know sey wi bi God shidren and dis world wey wi dey so, na wiked pipol dey rule am.


Dis leta na from Jude, Jesus Christ savant and James broda. To di pipol wey God don koll, wey Papa God love don wrap like klot for Jesus Christ body.


But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ