And na wetin I do for Jerusalem bi dat. Nor bi only sey I put many of di bilivers for prison with di pawa wey di priest oga dem give mi, but I even dey support wen dem sey make dem kill dem.
My king, around aftanoon for road, I kon si one kind lite from heaven wey shine pass di sun. Di lite shine round mi and di pipol wey dey follow mi travel.