5 So e sey, “Make yor leaders follow mi go der and if dis man do anytin wey bad, make dem akuiz am.”
But just as Paul won start to tok, Gallio kon tell di Jew pipol sey, “If na bikos of one offence or sirious wayo, I for listin to una komplain,
Wen one pesin tell mi sey dem dey plan to kill-am, naim I send am kon meet yu at wons and I still orda di pipol wey dey akuiz am make dem kom tok wetin e do for yor front.”
So wen yu ask am kweshon, yu go fit hear by yorsef all di tins wey wi sey e do.”
But I ansa dem, ‘Rome law nor gri make dem kondemn anybody wen e neva face and defend ensef before pipol wey dey akuiz am.’
But I kon si sey e nor do anytin wey go make dem kill-am and wen e sey e won make di emperor judge en kase, I kon gri sey I go send am go meet Caesar.
Den Festus ansa, Paul dey for Caesaria and mi mysef go soon go der.
Festus nor stay rish eight or ten days wen e go Caesaria and di next day, e sidan for di judgement seat kon give orda sey make dem bring Paul kom.