Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”
Den di ofisas go meet di king kon tell am, “Dis man must die, bikos wetin e dey tok, nor dey help di pipol; e dey kause pain kon make di sojas and evribody for di town, dey fear.”
kon take pamishon to go Damaskus, so dat if e si anybody wey dey follow Jesus Christ wey bi di Way, weda na man or woman, e go arrest dem kom Jerusalem.
Den e go dey rite if wi sey, “Make wi dey do bad tins so dat good tins go kom out from wetin wi dey do?” But some pipol dey lie for my head, bikos of wetin I tok and God go ponish dem.
I don travel many times wey I enter trobol for wota; for tif hand, even for my kountry pipol and Gentile pipol hand; both for inside town; for wildaness and from pipol wey dey pritend sey dem bi awa brodas.