18 Wen pipol wey dey akuiz am stand up, dem nor tok any bad tin against am as I bin suspet.
Den Pilate tell dem, “Make una go judge am as una law tok.” Di Jew oga dem kon sey, “Awa law nor give us pawa to kill anybody.”
But just as Paul won start to tok, Gallio kon tell di Jew pipol sey, “If na bikos of one offence or sirious wayo, I for listin to una komplain,
So afta dem follow mi kom here, I kon pospone di kase, but di next day I sidan for judgement seat kon orda make dem bring di man kom.
Instead, dem dey argue matter with am, about how dem dey serve God and one man wey dem dey koll Jesus Christ wey don die, wey Paul sey e still dey alive.
So e sey, “Make yor leaders follow mi go der and if dis man do anytin wey bad, make dem akuiz am.”