13 Afta some days, King Agrippa and Bernice go Caesaria, go salot Festus.
So e send Joram en pikin make e go kongratulate David for en viktory against Hadadeza wey King Toi don fight many times.
Jehu meet some pipol wey rilate to King Ahazaya for Judah. Jehu kon ask dem, “Who una bi?” Dem ansa, “Wi bi King Ahazaya family membas. Wi dey go Jezrel go greet Kween Jezebel and di odas for di palis.”
Dem kon dey salot am, “Wi hail yu o-o, Jew pipol king!”
Wen three days don pass, Festus komot from Caesaria go Jerusalem.
Festus kon sey, “Yu don tok sey make Caesar judge yor kase, so, na Caesar yu go-go meet!”
Den Festus ansa, Paul dey for Caesaria and mi mysef go soon go der.
So Agrippa tell Paul, “Make yu tok for yorsef naw.” Den Paul raiz en hand kon start to tok.
Filip si ensef for Azotus and as e dey waka pass for di aria, e kon dey prish di Good News for all di towns till e rish Caesaria.
Wen e don do di ofrin finish, Samuel kon kom. Saul kon go outside go greet am.
But one savant kon tell Abigail, Nabal wife sey, “David send pipol from desert make dem kon greet awa oga, but awa oga shaut give dem.