19 But some Jew from Asia suppose dey here dey tok di tin wey dem get against mi, if dem get anytin to tok at-all.
Wen one pesin tell mi sey dem dey plan to kill-am, naim I send am kon meet yu at wons and I still orda di pipol wey dey akuiz am make dem kom tok wetin e do for yor front.”
e kon sey, “I go hear yor kase wen di pipol wey akuiz yu rish here.” Den e orda sey make dem guide Paul for inside Herod palis.
But I ansa dem, ‘Rome law nor gri make dem kondemn anybody wen e neva face and defend ensef before pipol wey dey akuiz am.’