17 Afta many years, I kom Jerusalem back kon give gift to poor pipol and offa sakrifice.
Paul don sey e go travel pass Efesus make e for nor spend time for Asia, bikos e dey hurry make e for kwik rish Jerusalem for Pentekost Day.
So make una shine una eye and remember sey, for day and nite for three years, I nor stop to dey kry, as I dey warn una.
Di next day, Paul take di men and afta e don join dem do wetin Moses Law tok, e go di temple kon sey, dem don obey di law and dem ready to offa di sakrifice.
Bikos e dey hope sey Paul go bribe am, naim make am sey make dem bring Paul kom meet am many times.
Make una pray make God save mi from pipol wey nor bilive am for Judea and make di bilivers wey dey Jerusalem, asept wetin I dey prish.
Na dis make us beg Titus sey, as e don start, e good make e finish dis good work wey e dey do, bikos e love una.
Una know di grace wey awa Oga God Jesus Christ get; even doh e dey rish, e kon turn poor man bikos of una, so dat thru en poverty, una go dey rish.
Bikos dis work wey una dey do so, nor just dey help only God pipol, but e dey always make pipol, tank God.
But dem sey make wi always remember poor pipol and na wetin dey my mind to do, bi dat.