15 I get hope for God (di kind one wey dis men get too) sey one day, pipol wey don die, weda na bad or good pipol, go wake-up.
Many pipol wey don die go raiz; doz wey dey holy go get life wey nor dey end, while odas go sofa forever.
“So wiked pipol go enter ponishment wey nor go end, but raitious pipol go get life wey nor go end too.”
Den, God go bless yu, bikos dem nor go fit pay yu back, but na God go pay yu wen E go raiz en pipol from deat; di pipol wey do wetin E like.”
Den Marta sey, “I know sey e go wake-up again for di resureshon day.”
bikos if e pass dis one, I go shaut as I stand for dia front sey, ‘Una dey judge mi today, bikos I bilive sey pipol wey don die, go wake-up.’ ”
E go use en pawa wey make am Oga God for evritin, take shange dis awa ordinary body and awa body go kon bi like en own wey get glory.
God don bless di holy pipol wey join for di first resureshon! And dis pipol nor go die again, but dem go bi God and Christ priests and dem go rule with am for 1,000 years.