Bikos wi don si dis man sey e find trobol and kause wahala among all di Jew pipol for di world and naim dey lead di gang wey dem dey koll, ‘Di Nazarenes’.
Afta three days, Paul koll all di Jew pipol oga dem togeda. Wen dem don gada, e kon tell dem, “My pipol, even doh I nor do anytin against awa pipol or awa grand-grand papa dem tradishon, from Jerusalem naim dem turn mi to prisona kon karry mi give Rome pipol.