5 Paul ansa, “I nor know before sey naim bi di High Priest, bikos God word sey, ‘Make yu nor tok bad about di pesin wey dey rule yor pipol.’ ”
“Make una nor tok bad about God or curse who dey rule una.
Make yu nor curse di king for yor mind or curse rish pipol for yor room, bikos one small bird fit karry wetin yu dey tok and tink, go tell dem.
Di pipol wey stand near am kon sey, “Yu dey curse God High Priest?”
Afta many years, I kom Jerusalem back kon give gift to poor pipol and offa sakrifice.
Dis na di pipol wey dey do wetin dia body wont and dem nor dey respet pipol wey get authority. Dem nor dey fear; dem dey karry body up; dey tok bad about tins wey God kreate for heaven,