Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 23:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

35 e kon sey, “I go hear yor kase wen di pipol wey akuiz yu rish here.” Den e orda sey make dem guide Paul for inside Herod palis.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 23:35
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

den dem drag mi kom out kon take mi go di kourtyard.


Afta dem born Jesus for Betlehem wey dey Judea, for di time wey Herod bi king, some wise men from east kon go Jerusalem


Wen Herod si sey di wise men deceive am, e vex well-well, so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down, bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey, dem si di star.


Wetin dem tok so, vex King Herod and Jerusalem pipol.


Di sojas take Jesus Christ enter di govnor house and all of dem kon gada am.


Den, dem take Jesus komot from Kaiafas place go di Roman Govnor palis. (By dis time, morning don rish). Dem nor gri enter inside di govnor house, make dem nor for dirty as dia tradishon tok, so dat dem go fit chop di Passova food.


Wen one pesin tell mi sey dem dey plan to kill-am, naim I send am kon meet yu at wons and I still orda di pipol wey dey akuiz am make dem kom tok wetin e do for yor front.”


Wen five days don pass, Ananias, wey bi di High Priest, kom with some eldas and one lawyer wey dem dey koll Tertullus and dem read wetin dem sey Paul do, give di govnor.


Wen di govnor sey make Paul tok, e kon sey, “I know sey yu don bi judge for dis kountry for many years naw, so I nor go fear dey tok as I dey defend mysef.


But some Jew from Asia suppose dey here dey tok di tin wey dem get against mi, if dem get anytin to tok at-all.


Den Felix, wey bi sey e know di true story about di Way, pospone di kase kon sey, “Wen Lysias, di kommanding offisa kom, I go judge yor kase.”


E kon orda di soja oga make e guide Paul, but make e gi-am small freedom and make e nor drive en friends if dem won gi-am anytin.


But I ansa dem, ‘Rome law nor gri make dem kondemn anybody wen e neva face and defend ensef before pipol wey dey akuiz am.’


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ