13 Di pipol wey make dis bad plan pass forty.
As e dey offa sakrifice, e send message go Gilo town go koll Ahitofel, wey bi one among doz wey dey advise David. Dia plan against di king strong well-well and doz wey dey follow Absalom kon dey plenty more.
Wen dem tell David sey Ahitofel don join Absalom against am, e kon pray, “Oga God, I beg! Make any word or advise wey Ahitofel tok, dey yuzles!”
Dem go drive una komot for di sinagog and di time dey kom wen di pesin wey go kill una, go tink sey e dey do God work.
Wen morning rish, some Jew pipol kon gada dey make bad plan and dem swear sey dem nor go chop or drink anytin until dem kill Paul.
Dem go meet di priest oga dem and di eldas tell dem sey, “Wi don swear sey wi nor go chop anytin until wi kill Paul.