But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.
Di next day, bikos di kommanding offisa won know di rizin wey make di Jew pipol dey akuiz Paul, e release am kon orda di priest oga dem and di whole kansol make dem gada. So e bring Paul kon stand for dia front.
and even di High Priest and di kansol eldas know about mi. From dem, I kollect leta go give dia brodas wey dey for Damaskus, so dat I go arrest pipol wey bilive Christ kon bring dem kom Jerusalem put for prison.
So make una and di kansol tell di kommanding offisa make e bring Paul kom meet una, like sey una one judge en kase again. Wi ready to kill-am, before e go rish dis place.”
Den wen Paul know sey some pipol wey dey der na Sadusi and odas na Farisees, e kon shaut make di whole kansol hear, “My brodas, I bi Farisee, na Farisee pesin born mi. Dem dey judge mi today, bikos I put hope sey pipol wey don die go wake again!”
Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.
But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.
Anytime I remember yu for my prayer, weda na for nite or day time, I dey always tank God wey I dey serve with betta mind, just as my grand-grand papa dem serve am.
But make una do am with gentolness and respet, dey make sure sey una mind klean, so dat pipol wey dey tok bad about di good tins wey una dey do for Christ, go shame for di bad wey dem dey tok.