But wen some sturbon pipol nor gri bilive, dem kon dey spoil Jesus Christ name for all di pipol front, so Paul with en disciples kon leave dem. Paul dey take en disciples follow body evriday, go tish for Tirannus Hall.
But I go let yu know sey I dey woship di God wey awa grand-grand papa dem dey woship, as dia tradishon tok (wey dis pipol sey na one kind gang). Dem bilive evritin wey di law tok and wey di profets rite down.
Wen dem don drag am go outside for di temple, dem kon start to dey stone am, den dem kon pul all dia klot give one man wey dem dey koll Saul, make e whole.
Evribody wey hear am kon dey sopraiz dey ask demsef sey, “Dis nor bi di man wey dey kill pipol wey bilive Jesus Christ? Wi tink sey e kom here kon arrest pipol karry go give di priest oga dem.”
Bikos I really won do God work, I kon dey kause sirious wahala for di pipol wey dey di church. I do evritin just as di law sey make wi do, so dat wi go dey good for God eye. So, I nor get any fault.