Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 22:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 Di next day, bikos di kommanding offisa won know di rizin wey make di Jew pipol dey akuiz Paul, e release am kon orda di priest oga dem and di whole kansol make dem gada. So e bring Paul kon stand for dia front.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 22:30
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Make una dey ready, bikos pipol go arrest una karry go kourt and flog una for dia sinagog.


Dem tie am kon take am go meet Pilate, wey bi di govnor.


But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.


E waka kon meet us, take Paul belt tie en hand and leg kon sey, “Di Holy Spirit sey, ‘Na so di Jew pipol wey dey Jerusalem go tie di man wey get dis belt kon karry am give Gentile pipol.’ ”


Den di kommanding offisa arrest am kon give orda sey make dem tie am with two shain. E ask am who e bi and wetin e do.


and even di High Priest and di kansol eldas know about mi. From dem, I kollect leta go give dia brodas wey dey for Damaskus, so dat I go arrest pipol wey bilive Christ kon bring dem kom Jerusalem put for prison.


Paul look di kansol pipol kon tell dem, “My brodas, I dey live my life with klean mind for God eye kon rish today.”


So make una and di kansol tell di kommanding offisa make e bring Paul kom meet una, like sey una one judge en kase again. Wi ready to kill-am, before e go rish dis place.”


Di boy ansa, “Jew pipol dey plan sey dem go ask yu make yu bring Paul kom di kansol tumoro, like sey dem won ask am kweshon again.


Bikos I won know di offence wey e kommit, I kon karry am go dia kansol.


Den wen Paul know sey some pipol wey dey der na Sadusi and odas na Farisees, e kon shaut make di whole kansol hear, “My brodas, I bi Farisee, na Farisee pesin born mi. Dem dey judge mi today, bikos I put hope sey pipol wey don die go wake again!”


Paul ansa, “I pray to God sey, weda na naw or leta, nor bi only yu, but evribody wey dey here, go bi like mi, but make una nor sofa, as I dey sofa so.”


Afta dem hear dis, dem enter di temple varanda for morning kon start to dey tish di pipol. Den di priest oga dem and di pipol wey dey follow am kon koll di Sanhedrin, wey bi di big kansol for Israel pipol. Dem send pipol go di prison make dem go bring di apostles kom, bikos dem won judge dia kase.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ