28 Di kommanding offisa kon sey, “Na big money I spend to bi Roman citizin.” Paul ansa, “But dem born mi for Rome.”
So di kommanding offisa ask Paul, “Tell mi, yu bi Roman citizin?” Paul ansa, “Yes.”
Den doz men wey bi won ask am kweshon kon komot and fear katch di kommanding offisa wen e know sey Paul, wey dem tie, na Roman citizin.
Dat time, una dey without di Mezaya and una nor get share for Israel blessings and since una nor get hope and una dey without God for dis world, una kon bi strenja to God kovenant wey E promise Israel pipol.
So, una nor go bi strenja and pipol wey nor get share for Israel blessings again, but una go bi God shidren with all di pipol wey dey en house.