Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 22:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Wen dem don put am for groun make dem start to flog am, Paul kon ask di soja wey stand near am, “E dey rite make una flog pesin wey bi Roman citizin, wen dem neva judge en kase?”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 22:25
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Make una dey ready, bikos pipol go arrest una karry go kourt and flog una for dia sinagog.


Wen di sojas oga and di pipol wey dey guide Jesus Christ si di eartkweke and wetin happen, dem fear well-well kon sey, “True-true dis man na God Pikin.”


But di offisa sey, “Oga God, I nor big rish who yu go enter en house, instead just tok and my savant go well.


One man wey en name bi Kornelius dey stay for Caesaria and e bi offisa for Italy soja.


But Paul tell di sojas, “Dem sey make dem beat us for publik even wen dem neva judge awa kase, even doh sey wi bi Rome pipol, dem still trow us for prison. Naw, dem won free us from back make pipol nor for know? Wi nor gri! Make dem kom here by demsef kon release us!”


Wen di soja hear dis, e go tell di kommanding offisa, “Wetin yu won do so? Dis man kom from Rome o-o.”


Paul koll one soja oga kon tell am, “Take dis boy go meet di kommanding offisa, bikos e get sometin wey e won tell am.”


Di Jew pipol seize dis man and dem nearly kill-am before I rish der with my sojas. Wi kon save am from dia hand, bikos I find out sey, e bi Roman citizin.


But I ansa dem, ‘Rome law nor gri make dem kondemn anybody wen e neva face and defend ensef before pipol wey dey akuiz am.’


Wen dem don gri sey wi go travel inside ship go Italy, dem kon karry Paul and some oda prisonas give Julius, one kommander wey dey Augustan group.


Di next day, wi enter Sidon and Julius kon do good give Paul, e allow am go meet en friends make dem fit gi-am all di tins wey e nid.


But bikos di soja offisa one save Paul life, e nor kon let dem do wetin dem plan. E kommand di pipol wey fit swim, make dem first jump komot from di ship swim go land


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ