Na wetin dem rite for di leta, bi dis, “From di apostles and eldas wey bi una brodas, to all di brodas and sistas wey bi Gentile wey dey Antiok, Siria and Silisia. Wi greet una o-o!
But Paul tell di sojas, “Dem sey make dem beat us for publik even wen dem neva judge awa kase, even doh sey wi bi Rome pipol, dem still trow us for prison. Naw, dem won free us from back make pipol nor for know? Wi nor gri! Make dem kom here by demsef kon release us!”
“I bi Jew wey dem born for Tarsus wey dey Silisia, but na for dis town I for grow, I go skool and learn awa grand-grand papa dem law well-well under Gamaliel and I get mind to serve God well-well, just as una bi today.
Di Jew pipol seize dis man and dem nearly kill-am before I rish der with my sojas. Wi kon save am from dia hand, bikos I find out sey, e bi Roman citizin.
But some men kon dey argue with am. Dis men dey woship God for one place wey dem dey koll “Di Freedmen Sinagog.” Some among dem kom from Alexandria, Sirene, Silisia and Asia.
God tell am, “Get up make yu go di street wey dem dey koll ‘Strait’ and wen yu rish Judas house wey dey der, make yu look for one man, en name na Saul and e kom from Tarsus. Yu go meet am dey pray for der.