Dem kon seize Sostenes, wey bi oga for di sinagog kon start to beat am for di judgement seat front. But Gallio do like sey all dis tins nor koncern am.
Di Jew pipol seize dis man and dem nearly kill-am before I rish der with my sojas. Wi kon save am from dia hand, bikos I find out sey, e bi Roman citizin.
So dem bring di apostles kom back kon tell dia savant make dem flog dem. Afta dem release dem, dem kon warn dem sey make dem nor use Jesus Christ name take prish again.