As Adonijah with all di pipol wey e invite dey finish dia party, dem kon hear di nois. Wen Joab hear di trumpet, e ask, “Wetin dey bring dat kind nois for di town?”
But di Jew pipol dey jealous, so dem kon gada aria boys wey dey waka about for market, take form gang to skata di town. Dem attack Jason house, bikos dem tink sey Paul and Silas dey der, so dat dem go bring dem out kon take dem go di town hall.
So di next day, Agrippa and Bernice kon dey make yanga enter di hall, with all di big men wey dey di town. Afta Festus don give orda, dem kon bring Paul.