26 Di next day, Paul take di men and afta e don join dem do wetin Moses Law tok, e go di temple kon sey, dem don obey di law and dem ready to offa di sakrifice.
take dem follow body make una go do wetin Moses Law tok and make yu pay all di money wey dem spend take shave dia head. Den, evribody go know sey all di story wey dem hear about yu, nor bi true and dem go si sey yu yorsef dey obey di law.
Wen I dey with Jew pipol, I dey live like dem, so dat I go win dem for Christ. Na Moses Law dem dey follow, but I nor dey follow dat one. But I dey live as di law tok, so dat I go win souls kom meet Christ.