So di church send dem go and as dem dey go, dem pass Foenicia and Samaria kon tell pipol wey dem meet for der how Gentile pipol take turn from dia sin kom meet God and di story make all di brodas wey hear am, happy well-well.
Some disciples from Caesaria follow us go, dem kon take us go Mnason house for Cyprus. Dis Mnason dey among di first disciples and wi stay der with am.
Wen wi don stay der for sometaim, wi kon travel komot der. All of dem with dia wife and pikin escort us go outside di town. Wi knee down pray for di wotaside
But I nor know wetin I go rite go give di emperor about am. So naim make mi bring am kom all of una and king Agrippa front, so dat afta una don kweshon am finish, I go get sometin wey I go fit rite.