Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 20:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 Even among una, some men go stand dey tish lie-lie tins kon draw pipol follow body.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 20:30
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E betta make pesin dey poor and get good karata, dan make e bi fool wey nor get trut for mout.


Yor eyes go si tins wey go sopraiz yu and yu nor go fit tink or tok well.


All una words na lie and pipol wey una kill, dia blood don stain una hand.


God go help en pipol small wen dem fall. But some pipol go play wayo kon join dem.


“E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey travel go evriwhere just to win one pesin kon meet God and afta una don win am, una go kon make am bad well-well like devil pikin, pass as una bi!


and wen e si am, e kon take am go Antiok. Banabas and Saul stay der for one year dey tish di pipol wey dey di church and na for der dem for first koll di disciples, “Christians.”


So nor bi yu bi dat Egypt man wey start wahala kon karry 4,000 men wey dem dey koll ‘Asassins’ go inside wildaness?”


Bikos dem bi fake apostles; pipol wey dey lie and pritend like sey dem bi Jesus Christ apostles.


For di same time, dem go dey lazy, dey waka from house to house, dey do aproko and tok anyhow.


and wahala, naim e dey kause. Dia mind don spoil and dem nor know di trut again, bikos dem tink sey dem fit use God work take make money.


Dem dey use dia big-big grammar wey nor mean anytin, take deceive pipol wey just dey won komot hand for bad tins.


Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.


Bikos pipol wey dey deceive odas, don enter di world; dem nor gri sey Jesus Christ don kom dis world as human being before. Dis kind pipol dey deceive odas and na anti-Christ dem bi!


But all dis tins dey happen make e for betta for yu, bikos yu hate di tins wey Nikolaitan pipol dey do and I hate doz tins too.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ