How I wish dem know wetin I dey tink for my mind, den dem for fit prish my message give my pipol, so dat dem go stop di kind life wey dem dey live and di bad-bad tins wey dem dey do.
sey, “Go di temple go tell all di pipol from Judah wey dey kom woship for der, evritin wey I kommand yu. Make sure sey yu nor forget anytin wey I tell yu.
E kon tell mi, “Man pikin! Listin well-well and look evritin wey I dey show yu, bikos dis na di rizin why dem bring yu kom der, so dat yu go tell Israel pipol evritin wey yu si.”
I nor go koll una savant again, bikos savant nor dey undastand wetin en oga dey do, but I dey koll una my friend, bikos I don show una evritin wey I hear from my Papa.
na Judas sell dis man give Jew pipol, bikos na so God plan am from biginnin. Una know sey una kill-am, wen una gi-am to di sojas make dem nail am for cross.
Like dis, I don show una sey wi must help pipol wey dey weak and una remember wetin Jesus Christ tok, wen e sey, ‘E betta make pesin dey give pipol tins, dan make e dey kollect from dem.’ ”
But wi don stop to dey do wiked tins wey pipol dey hide dey do; wi nor dey do wayo or lie join God word, but with trut wey evribody fit si, wi dey make evribody know for dia mind sey, wetin wi dey do, dey good for God eye.
but na God choose us to prish di gospel and na so wi dey prish am. Wi nor dey do am make pipol for praiz us, but make God wey dey si awa heart, praiz us by ensef.