“I don tell una all dis tins, so dat my peace go stay with una. Wahala full inside di world and sofa dey too, but make una heart dey strong, bikos I don already win di world.”
Dem enkourage di disciples sey make dem get heart and make dem kontinue to dey bilive sey, “Wi go must sofa well-well for pipol hand, before wi go fit enter God Kingdom.”
But I nor kount my life to mean anytin, so dat I go fit finish my work and di ministry wey I receive from Jesus Christ, wey bi to prish about di Good News wey go make pipol undastand God grace.
E waka kon meet us, take Paul belt tie en hand and leg kon sey, “Di Holy Spirit sey, ‘Na so di Jew pipol wey dey Jerusalem go tie di man wey get dis belt kon karry am give Gentile pipol.’ ”
Wi kon go find di disciples wey dey for di town, wen wi si dem, wi stay with dem for seven days. Dem kon tell Paul many times sey make e nor go Jerusalem.