Na wetin dem rite for di leta, bi dis, “From di apostles and eldas wey bi una brodas, to all di brodas and sistas wey bi Gentile wey dey Antiok, Siria and Silisia. Wi greet una o-o!
As dem dey go from town to town, dem kon dey pass di message wey di apostles and eldas for Jerusalem send to all di Gentile pipol wey bilive Christ sey, make dem obey.
Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.
Mi wey bi elder dey rite dis leta to di woman wey God choose, with en shidren wey I love inside di trut (nor bi only mi, but na evribody wey know di trut).