12 Dem take di boy go house kon dey happy sey e dey alive.
Awa God sey, “Make yu konfort my pipol! Konfort dem well-well!
Den Paul go upstair and afta e don break bread with dem, e follow dem tok till day break. Den e kon komot from der.
Wi waka go where di ship dey kon go Asoss, so dat wi go karry Paul for der, bikos e plan sey e go pass land go der.
E dey help us wen wi dey trobol, so dat wi go fit help odas thru di help wey E help us.
Na bikos of dis I send am kom meet una, make una for know how tins dey with us for here and make e for fit enkourage una heart.
So wi kon send Timoti, awa broda wey dey follow us do God work sey, make e kom enkourage una koncerning una faith,
So make una dey enkourage each oda with all dis word.
So make una dey enkourage and help each oda, just as una dey do naw.
Wi dey beg una, awa brodas and sistas, make una tell pipol wey dey bihave anyhow sey, wetin dem dey do nor good, den make una help doz wey dey weak, but make una dey patient with evribody.
Naw I dey pray sey, God wey love and give us betta konfort thru en grace and hope,