Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 2:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Wi wey kom from Partia, Medes, Elam, Mesopotamia, Judea, Kappadocia for Pontus and all di aria wey dey for Asia,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 2:9
34 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Shem shidren na Elam, Asshur, Arfaxad, Lud and Mash.


For dat time, Amrafel wey bi Shinar king, Ariok wey bi Ellasar king with Kedorlaoma wey bi Elam king and Tidal wey bi Goyim king


Den di savant take ten kamel from en oga own kon go with difren gifts from en oga, just as e wont. E travel go Aram Naharaim aria for Nahor town.


For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.


Wen King Hanun and Ammon pipol know sey dem don make David dia enemy, dem kon use about 75,000 pound for silva take go hire men from Aram Naharaim, Aram Maaka and Zobah.


But na for Ekbatana town for Media aria naim dem for si one book wey get dis rekord:


Wen dat day rish, Israel pipol wey dey Assyria, Patros, Sudan, Elam, Babilon, Hamat, di towns wey dey near di sea and Egypt, God go use en pawa take bring dem kom back to Jerusalem.


I si one bad vishon sey, “Di pesin wey dey lie, go lie well-well and di one wey dey distroy, go distroy well-well. Elam sojas, make una attack! Media sojas, make una hide attack di towns! But God go end all dis wahala.”


Farsin (division) mean sey: ‘Dem go divide yor kingdom give Mede and Persia pipol.’ ”


For dis vishon, I si mysef for Shushan wey dey Elam aria. As I stand near Ulai river,


Di ram wey yu si wey get two horn, na di two kings for Mede and Persia.


Dem pass thru Frigia and Galatian aria, bikos di Holy Spirit warn dem sey make dem nor prish di message for Asia.


For der, e kon si one Jew wey dem dey koll Akwila, wey kom from Pontus and e just kom back from Italy with en wife Priscilla, bikos Klaudius orda sey make all Jew pipol komot from Rome. Paul go meet dem


Dis tin kontinue for two years until evribody wey dey stay for Asia aria, weda na Jew or Greek, hear God word.


So, if wi nor do sometin, awa business go spoil and nor bi only dat one, but pipol nor go respet di temple wey awa juju, Artemis, dey stay again and dis woman wey di whole Asia dey woship, nor go get pawa again.”


Even some for di oga dem wey bi en friend, send message go meet am sey, make e nor enter di stadium.


How e bi sey dem dey speak awa difren language?


Paul don sey e go travel pass Efesus make e for nor spend time for Asia, bikos e dey hurry make e for kwik rish Jerusalem for Pentekost Day.


Wen dem kom, e tell dem, “All of una know how I dey live my life since di time wey I dey with una and from di first day wey I enter Asia;


Pipol wey follow Paul go, na Sopata, wey bi Pyrrhus pikin wey kom from Berea; Aristakus and Sekundus wey kom from Tesalonika; Gaius from Derbe; Timoti with Tikikus and Trofimus wey kom from Asia.


Wen di seven days don dey finish, di Jew pipol wey kom from Asia kon si am for di temple, naim dem start wahala and pipol kon gada. Dem seize Paul


Dis na wetin I dey do wen dem si mi for di temple; I dey klean and I nor gada any crowd or disturb anybody.


Wi enter one ship from Adramyttium wey won travel go difren place for Asia sea kon bigin travel go Aristakus and one Masidonia man wey dey stay Tesalonika, follow us.


But some men kon dey argue with am. Dis men dey woship God for one place wey dem dey koll “Di Freedmen Sinagog.” Some among dem kom from Alexandria, Sirene, Silisia and Asia.


Stefen ansa, “My brodas and fada, make una listin to wetin I won tok so. Na wen Abraham, awa grand-grand papa dey for Mesopotamia, before e go stay for Haran, naim God wey get pawa, appear to am


Make una still help mi salot di pipol for di church wey dey meet for dia house. Salot Epaenetus, my good friend (di first pesin to bilive Christ for Asia).


Pipol for di church wey dey Asia aria dey greet una; Akwila and Priscilla with di church pipol wey dey meet for dia house, dey greet una too.


My brodas and sistas, wi wont make una know about di wahala wey wi face for Asia aria. Di trobol wey wi face, heavy well-well and life kon taya us.


Dis pipol nor welkom una with food and wota wen una kom out from Egypt. Instead dem hire Balaam wey en papa bi Beor from Petor wey dey Aram Naharaim sey make e curse una.


Yu know sey evribody for Asia, Figelus and Hermogenes aria, don run leave mi.


Na mi Pita wey bi Jesus Christ apostle rite dis leta to di strenjas for Pontus, Galatia, Kappadocia, Asia aria and Bitynia wey God choose sey,


“Make yu rite evritin wey yu dey si inside dis book, den send dem go meet di pipol wey dey di seven church wey dey for Efesus, Smyrna, Pergamum, Tiatira, Sardis, Filadelfia and Laodicea.”


Na John rite dis leta go give di seven church wey dey Asia aria. Make grace and peace dey with una from di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go still kom. From di seven spirits wey dey en throne front


So God vex well-well kon send dem go serve King Kushan-Rishataim for Aram Naharaim for eight years.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ