bikos word wey wise pesin tok, bi like di sharp stik wey shepad dey use and wise words bi like word wey dem nail well for wall and na God bi di Shepad wey give us all dis tins.
“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.
Den some sojas kon still ask am, “Wot of us? Wetin wi go do?” E tell dem, “Make una nor use force kollect money from anybody hand or lie for anybody head and make una salari, rish una.”
Wen dem hear wetin e tok, dem kon dey komot for der one-by-one. Na di old pipol first start to komot, till e remain only Jesus and di woman wey stand for en front.
So I ask am, ‘Oga God! Wetin yu wont make I do?’ God ansa, ‘Get up make yu go Damaskus; for der, dem go tell yu evritin wey God don choose sey yu go do.’