Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Acts 2:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 Wi know sey en na profet, bikos God don promise am sey, naim pikin dem go always bi king for Israel.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Acts 2:30
37 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“God Spirit dey tok thru mi; en message dey for my lip.


So, God go give una sign by ensef. One yong woman wey neva ever sleep with man before, go get belle kon born boy pikin and dem go koll am, ‘Immanuel, wey mean, “God dey with us.” ’


Dem go serve mi wey bi di Oga dia God and na one of David shidren-shidren, go bi dia king.


But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.


Jesus ask dem again, “Den, how kom David koll am, ‘Oga God’, thru God Spirit, wen e sey,


Wen dem don nail am for cross, dem kon gambol take divide en klot.


Di Holy Spirit pawa make David tok sey, “ ‘God tell my Oga God, sidan for my rite hand until I go put yor enemies under yor leg.’


Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.”


“My brodas, di word wey di Holy Spirit use David tok about Judas, wey show road to di pipol wey arrest Jesus Christ, must happen,


Profet Isaya sey, “Somebody dey kom from David family (Jesse rut). E go rule Gentile pipol and dem go bilive am.”


Remember Jesus Christ wey kom from David family; di pesin wey God raiz from deat; bikos na so e bi for di message wey I dey prish


Before-before, God tok to awa grand-grand papa dem for many ways, thru di profets,


As di Holy Spirit tok: “If una hear God vois today, make una listin to am!


But God don plan anoda time wen wi go enter en rest and dat time, “Na today”, bikos E don tok am for en word before thru David.


So wen God won show en pipol sey E nor go break en promise, E kon swear with ensef.


but Jesus kon bi priest wen God sey, “I don swear and I nor go shange my mind sey yu go bi priest forever.”


bikos know profesy don ever kom out from human being mind. Instead, na di Holy Spirit dey kontrol di pipol wey dey tok God word.


Dem go follow di Lamb fight war, but di Lamb go win dem, bikos na en bi Oga God for all ogas, King for all kings and pipol wey dey follow di Lamb, na doz wey e koll, choose and save.”


For en klot and lap, wetin dem rite put na: “King and Oga God wey big pass.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ